Ticker

10/recent/ticker-posts

Header Ads Widget

Wetin we know about Ibadan explosion as Oyo goment urge residents to stay calm


Ibadan explosion

WIA DIS FOTO COME FROM,SCREENSHOTS

Di Oyo State goment don urge residents say make dem remain calm afta explosion rock Ibadan, di capital city for di late hours of Tuesday 17, January

Residents for di state capital flood social media to share videos of di impact of di explosion.

Di Oyo State goment for dia X account tok say dem dey aware of di explosion and add say security agencies dey investigate to determine di source and cause of di incident.

Di Oyo State police tok-tok pesin Wale Osifeso tell BBC News Pidgin say di explosion happun around Dejo Oyelese Street, Bodija, around 7:44pm today.

“Di cause of the explosion dey unknown.

Post a Comment

0 Comments